Information Wey Dey important about anti-corona vaccination 

E Dey safer  if you show more care 

E Dey safer  if you show more care 

Dey active in the vaccination process, ask any questions Wey you wan know about vaccine and tell the workers  there about any fear or worry 


Which vaccine we dey talk about ?

Pfizer e Moderna

The pfizer and modern vaccines na Mrna type and dem dey call am covid-19 Mrna Bnt162b2(comirnaty-pfizer)and corona 19 modern vaccine Mrna-1273. E dey safe and e dey work well well and fast too d side effect dey light and e go away by hinself after some days

Astrazeneca e Johnson & Johnson

D vaccine Astrazeneca and johnson&johnson na viral vectors and dem dey call am Vaxzevria(astrazeneca) and janssen (johnson &johnson). E dey safe and e dey work well well and fast too d side effect dey light and e go away by hinself after some days

Wetin be corona 19 vaccine and na wetin e de do?

Pfizer e Moderna

The vaccine na to avoid make the corona no catch people wey dey 12 years or more, The vaccine no get the corona inside am and e no dey give any disease.

Astrazeneca e Johnson & Johnson

Viral vector vaccine na the vaccine to prevent coronavirus disease 2019 for people wey don reach from 18 years up. For Italy Astrazeneca vaccine dem dey advice make dem usem for people wey don reach 60years or above.

Dem don make the viral vector no come get power so e no go fit spread enter body again.

how dem dey take give di vaccine?

Pfizer e Moderna

Na 2 times dem dey give the vaccine injection and na for the muscle in the upper hand pfizer na 21days before you go take the 2nd one then 28 days if na the modern one you take.

Astrazeneca e Johnson & Johnson

Na for upper arm muscle dem dey give vaccine injections, Astrazeneca na 2 injection 10 weeks from the 1st one , then Johnson&johnson na one single dose (one injection).

Wetin dey inside?

Pfizer e Moderna

Na Molecule (messenger RNA) dey inside the vaccine wey produce antibodi to make the corona make e dey weak.

Astrazeneca e Johnson & Johnson

The vaccine get adenovirus we no fit produce o carry the virus , e dey produce outside protein wey dey help bring out immune wey go fight so go begin produce anti-bodi.

How dem take find out?

For them to bring out this vaccine dem follow every step and use security , in this case the time wey dem use bring out the vaccine dey quick thanks for the knowledge wey dem face befor for other virus wey look like this one, wey make every bodi agree and put money, and the state wey agree the first testing.

D protection go start after the injections?

Pfizer e Moderna

No, dey show say e go begin work after 7 days of (Pfizer) or 14 days of the (modern one) from the second injection

Astrazeneca e Johnson & Johnson

No, dey show say e go begin work after 2 weeks from the last injection

What other reactions dem find out?

The reactions genarally dey light and mild and dey solve am after some days from vaccine injection,d kind things wey go appear be like pain,swelling and some red for d place d niddle enterm tiredness,headache, muscle and joint pain, cold and fever, vomiting, swelling up of the throat.

They discover rare venous for abnormal places, for people wey don reach 60 years or more that one na the possibile side effect of the Astrazeneca vaccine.

Dem no confirm any risk factors.

Upon say the reaction dey come mostly after the 2nd dose.

Why e dey important to take vaccine?

The vaccination plan go give the result expected if pleanty people go take the vaccine fast.

The gain of vaccine to avoid corona disease dey high pass the risk.

People wey take vaccine go still fit pass corona to other person?

Even though the vaccine dey protect against infection, people wey don take vaccine and people wey come close to dem go still dey carefull, and use the corona measures against corona 19.

Who i go meet if after the injection i get reaction(pain,swelling by the time of the injection, tirdeness headache, muscle pain, cold, fever and other things…..?

E dey important to report the event

to the pharmaceutical manager in charge at the U.S.L (hospital) with dis addresses:

E dey possible:

For other information visit the site: www.regione.toscana.it/-/vaccinazione-anti-covid-19