Medicine make you no get belle

The state of Tuscany dey promot and dey protects the reproduction health of young children and women with particular programs, dem dey teach dem about health education and sex education, so as to avoid belle wey person no want and abortion , HIV and disease wey people dey carry tru sex , make dem make their choice and know also about things to do as to avoid belle or disease.

Contraception na all the whole system wey go make say person no go get belle after sex . pills or other things wey person dey usa to avoid to get belle when person no want am, e go help make person choose when e wan get belle and to become mama.

E good for person to know how to protect himself, so you go choose the one wey you like to use beacause all bodi no be the same. e get pleanty reason way person no go want get belle when e no want am, belle wey fit affect your life. to use proctection go make person enjoy sex and e no go carry any disease and the person go enjoy sex without fear.

The hospital dey give information and advice about protection (pill) and to promot who wan be mama and papa, dem dey give protection pills , condom and others free of charge if i be say you no get money to buy am, or your condition fit no allow you to buy am( after you don born pikin, after abortion, if you never pass 24 years )."Emergecy pills na free too if you dey fear say you have sex and you fit come carry belle"you fit go for emmergency ward and ask dem to give you the pills if the hospital don close and doctors no come dey.

Dem dey offer:

Information materials