Help for peolpe from anoder kontry wey de say dem get belle
Down dem write the information of how imigrante go fit get help when dem get belle
Which type of help dem fit get
For this kontry dem dey protect and help women wey get belle free of charge even when dem born the pikin no matter if dem get document or no
For real the law say even person get belle fit even ask for document for him health and e go apply for sanitary card the same way like Italian people.
Dem go give document for the husband of the women wey get belle if dem dey live together , so hin can also apply for sanitaruy card code
Wetin wey you need to apply for tessera sanitary
For person to apply for saniatry card code if e get belle dem need:
- Fotocopy of the person I.D
- Certificate say the person get belle and when e go born the pikin
- Official stamp (marca da bollo) wey dem dey sell am 14 euros
- 4 pictures of passport foto
Immedieately the person get the document for sake if the belle wey him get , the person go apply for sanitary card code
- Permit to stay or reciept wey show say you don apply
- national fiscal code(codice fiscale)
- proof, or self certified to show place where you dey live
For how long the applicatione dey last for the person wey ask becose of belle ?
you fit do the application after the personn get the certificate say e get belle and after 6 months wey e born the pikin
Dem go cancell the document if the person go commot the belle on hin own, but dem go renew am for 6 months after e born the pikin even if the pikin die when dem dey born am