Urgent Emergency

Information for using the services

Only number for emergency in European NUE 112

The Nue 112 (only number for emergency in European 112) na the service wey allow only dial a single number, 1 1 2 (one, one, two), to ask for Medical help, the State Police, Carabinieri, of the Fire service.

The call na free from house phone and mobile phones and e dey translate for many languages, help also for people wey get problem for ear or wey no dey hear well.

Person fit ask for help with the "Where Are U" app (download me here) or send am from the "eCall" devices wey dey inside motor wey dem register new. Any how the help take come, dem go find were you dey within a few seconds.

Emegency ward

The emergency ward na service wey dey keep for all emergencies and any health emegency matter.

Any treatments wey the doctors wey dey for the emergency ward see say e no be emergency one the person go pay, dem go still do you check.up but you go wait for long time. the truth be say , for that place e no dey work like first come first serve.

For matter wey no be emergency o deadly the person go meet him family doctor /chidrem doctor and the Services wey dey on( standby doctors).

You fit go to the emergency ward directly or by ambulance if you call 112. Even if you come to the ward with ambulance that one no mean say dem go attend to you first.

Waiting room wey dey inside the emergency ward na where the nurse go check who dem go attend to, that one go depend on how your bodi dey do you and wetin the nurse find out.

The time wey dem go attend to you go depend with a code from 1 to 5:

1. EMERGENCY ► QUICK HELP

2. URGENCY ► WEY DEM NOT FIT POSTPONE

3. URGENCY ► WEY DEM FIT POSTPONE

4. URGENCY ► CHILDREN

5. E NO BE URGENT MATTER

Route dey for person wey get special need, (eg. PINK CODE victims of violence) or anoda way wey dem go organise to send the person to specialise clinic for emergency (Fast Track), or nurse wey dem don train well well fit treat you (See & Treat)

If dem see say the code na 4 or 5, you go pay ticket. this code wey dey here no go pay ticket even if thier matter no be urgent for emergency ward :

Pink code

The Pink Code na free entre to the Emergency ward dem dey activate am when violence dey involve , especially if na against women, children and people wey be victims of hatered .

Workers wey dey work for the emergency ward na dem dey activate am, even and ordinary hospital ward , patient from outside clinics and counsulting centers (midwife centre).

Through the Pink Code e dey possible to get help immediatly, protection and care iclude the person with other route wey dey together with institutions, like the Anti-violence Centers.